Dia Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem leave en temple kon bigin woship Asherah and difren juju. Bikos of dia sin, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol.
Wetin dem rite for di profets book still get: en prayers and how God take ansa am; all en sins and di bad tins wey e do; where e build high place with Asherah juju before e turn to Oga God.
“E don tey wen una rijet my kommand or obey and woship mi. Instead, una give unasef to all di gods wey dey di hill and under evry green tree, like sey una bi ashawo wey dey find who e go sleep with.
Wen King Josaya dey rule for Judah, God tell mi sey, “Israel pipol wey nor dey faithful, yu si all wetin dem dey do? Dem don waka leave mi kon dey do ashawo for under evry green tree and high hill.
Dia shidren dey gada firewood; men dey make di fire and di wimen dey mix flower wey dem go take bake kake for dat juju wey dem dey koll, ‘Heaven Kween.’ Dem still dey pour wine give oda gods as ofrin and dis tin dey make mi vex.
I bring dem kom di land wey I don promise sey I go give dem. Wen dem si how di tree for der fine and how di mountin tall rish, dem kon bigin sakrifice give di tree and mountins. Dem make mi vex, bikos of di sakrifice wey dem dey burn and di wine wey dem dey offa as ofrin.
Wen una porshu di kountries wey dey der, una must distroy all di place wey dem for dey woship dia gods, both for di mountin, on-top di hill and under evry tree.