Pipol go ansa, ‘Na bikos dem abandon di Oga wey bi dia God wey bring dia grand-grand papa kom out from Egypt. Dem dey respet and woship oda gods, so God kon give dem dis kind big wahala.’ ”
Odas go ansa sey, ‘Na bikos dem nor obey di Oga wey bi dia grand-grand papa God; di One wey take dem komot from Egypt. Dem dey serve and woship oda god with all dia mind. Na dis make God dey ponish dem like dis.’ ”
And wen una ask, “Wetin make all dis tins dey happen to us? Why dem tear awa klot komot from awa body kon trit us like ashawo? Na bikos of sin?” Yes! Na bikos una don sin.
Una priests nor even ask sey, ‘Where Oga God dey?’ Doz wey dey tish my law nor even know mi. Una rulers don turn from mi. Una profets dey profesai with Baal name and una leaders dey woship juju wey nor fit help or save dem.
Den, put dem under sun, moon and stars. Bikos dis na di tins wey dem love; tins wey dem dey woship, serve and koll make e kom guide dem. Nobody go gada dis pipol bones go beri again; so dem go bi like manure wey dem pour for groun.
But pipol wey still like to woship juju and do bad tins, I go ponish dem. I go ponish dem for di tins wey dem don do.” God wey get pawa well-well don tok.
God sey, “Bikos Judah pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem hate wetin I tish dem and nor gri obey my kommand. Di same lie-lie gods wey dia grand-grand papa dem serve, don deceive dem too.
Na from una grand-grand papa time, una don turn komot from my law and nor gri obey mi. Make una turn back kom meet mi and I go turn kom meet una. But una dey ask, ‘How wi won take turn kom meet Yu wen wi neva leave Yu before?’