Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 15:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 So, wetin make mi still dey sofa? Why I go dey bear dia curse like sore wey nor get cure? Yu dey plan to leave mi like stream wey dry?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 15:18
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Like wota wey stop to flow and river wey dry,


E sey, ‘As I dey rite so, make I lie sey I dey wrong? Dem nor fit heal my wound, even doh I nor sin at-all.’


I dey fear well-well. Na how e go tey rish, before Yu go kon save mi?


Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.


Rish pipol send dia savant go fetch wota for well, but dem nor si wota fetch, so dem kom back with dia empty kontaina. Dem kover dia face, bikos dem dey shame and dey konfuse.


Why dem born misef? Na make I for si trobol and always dey kry, so dat my life go end with shame.


My God, Yu don deceive mi! Yu don deceive mi so dat I go bi yor profet? Yu strong pass mi and Yu get pawa well-well. Naw, evribody dey look and laf mi.


God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.


Make una nor komplain about una sore again, bikos e nor get cure. I dey ponish una like dis, bikos una wikedness and sin, too mush.


So, make una tell Moreshet-Gat town bye-bye. Na Akzib pipol deceive Israel king.


bikos my pipol sore too deep and e don even rish Judah too. Yes! E don rish Jerusalem gate.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ