Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 14:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 14:12
32 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa. Una fit go find mi for evriwhere, but una nor go si mi.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.


If yu nor dey obey di law, God nor go hear yor prayers.


Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.


So, mi wey bi God sey: ‘I go soon distroy dem and dem nor go fit eskape. I nor go listin to dem wen dem kry kom meet mi for help.’


So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”


Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!


Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.


I go kill evribody for dis land. Na bad diziz I go take kill both di pipol and dia animals.


I go bring war, honga and diziz kom meet dem, until nobody among dem go remain for di land wey I give dem and dia grand-grand papa.’ ”


Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.


Dia gift wey dem dey bring from Sheba or di incense wey dem bring from far land nor mean anytin to mi. I nor go fit asept dia ofrin again and dia sakrifice nor fit make belle sweet mi.’


“I bin won gada my pipol, just as farmers dey gada wetin e harvest, but dem bi like vine wey nor get grape or dry fig tree wey nor get fig. Bikos of dis, I go let strenjas take dia land.”


I go skata dem go difren nashons wey dem or dia grand-grand papa neva hear of before kon send sojas go fight dem, until I don distroy dem finish.’ ”


“If I send betta diziz go dat kountry kon kill many pipol and animals, bikos I dey vex


Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.


So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”


Even wen dem kom sakrifice animals give God make E for favor dem, dem nor si am bikos E don turn from dem.


God sey, “I hate di juju feast wey una dey do; I nor fit bear dem!


But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”


“Bikos dem nor gri listin wen I tok to dem, na so too I nor go listin anytime wey dem pray to mi.


God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”


Dis na anoda tin wey una dey do: Una go kry until una tear go full God altar, bikos E nor asept di sakrifice wey una bring kon gi-am.


So I look kon si one horse wey en kolour bi like green wey don dey fade! Di pesin wey dey ride am, na Deat dem dey koll am and en friend na di Grave. Wen dem divide di eart into four, dem give di two of dem pawa ova one part, so dat dem go kill pipol with dia swod; honga; diziz and wiked animals.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ