So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”
Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!
Den God tell mi, “Jeremaya! Make yu nor pray for dis pipol. Make yu nor kry or pray give mi bikos of dem! Nor beg make I save dem, bikos I nor go listin to yu.
If anybody si en broda or sista for Christ dey kommit sin wey nor go kill-am, make e ask God and God go give life to dat pesin. E get di kind sin wey dey kause deat and I nor sey make una pray make God forgive di pesin wey dey kommit dat kind sin.