Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 13:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 And wen una ask, “Wetin make all dis tins dey happen to us? Why dem tear awa klot komot from awa body kon trit us like ashawo? Na bikos of sin?” Yes! Na bikos una don sin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 13:22
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.


But I go ponish dem, I go kut dia hair kon shave dia head to bololo.”


Naw, make yu listin, yu wey dey enjoy yorsef kon tink sey yu dey save and sikure. Yu tell yorsef sey, ‘I too mush and nobody bi like mi. My husband or shidren nor go ever die.’


Na only God go tear una klot komot for una body kon disgrace una.


And di pipol wey dis fake profets dey profesai to, na war and honga go kill dem too. Dem go trow dia dead body for evriwhere for Jerusalem street and nobody go dey to beri dem. Dis tin go happen to all of dem, dia wifes and dia shidren. I go make dem pay for all di bad-bad tins wey dem dey do.”


So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask, “Wetin make di Oga God ponish us like dis? Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods for dia land and bikos of dat, una must go serve as slave for anoda land.’ ”


Bikos Jerusalem sin well-well, God kon rijet dem like dirty rag. All di pipol wey dey honor am before, don hate am naw, bikos dem don si en nakednes and shame. Di only tin wey e fit do naw, na to dey kry with pain and hide en face with shame.


Dem go tear yor klot kon take all yor gold.


Efraim pipol sey, “Wi get money well-well and nobody go fit akuse us sey wi use wayo take get awa money.”


I go naked am for en lovers front and nobody go fit save am from my pawa.


If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.


Dia mama sey, “I go-go meet my lovers, bikos na dem dey give mi food, wota, wool, linen, olive oil and wine.”


Oga God sey, “I bi una enemy! Naw, I go let all di nashons si una nakednes, den shame go katch una.


I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.


“But una fit ask unasef, ‘How wi won take know sey, dat message nor bi from God?’


Una fit tink and ask, “Dis kountries many pass us, so how wi go take distroy dem?”


E do all dis tins, so dat una nor go kon dey tell unasef sey, “Na my own pawa and work, I take get all dis tins.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ