“E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.
God don forget en pipol like lion wey waka komot for en kage go find food. Dia kountry don turn desert, bikos dem dey fear pipol wey dey opress dem and dem dey fear God vexnashon too.”
‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.
God sey, “I go take una back as my shidren kon give una betta land; di land wey fine pass for di whole world. Den una go koll mi, ‘Papa’ and una nor go turn from mi again.
Wen dem attack Jerusalem, Babilon sojas go pozishon demsef for di Middle Gate and Nergal-Sharezer wey kom from Samgar, Sarsechim and anoda Nergal-Sharezer wey bi senior ofisas dey among dem too.
So I kon sey, “I go kry and mourn for di grass wey dey on-top mountin, bikos dem don dry and nobody dey travel pass der again. Dem nor dey hear fawol nois for der again and even bird and wild animals, don fly komot der.”
“Man pikin, go tok against di leaders for Israel. Tell dem sey mi wey bi God sey: ‘Una wey dey kare for Israel pipol, una own don finish! Una guide unasef kon leave Israel pipol on dia own.
Den I hear one angel dey ask anoda one sey, “How long dis tin wey dey happen for dis vishon go kontinue? Dis wiked tin wey dem dey do go replace di sakrifice wey dem dey do evriday? How long di sojas wey dey heaven and di temple go dey under en leg?”
Instead, I go skata and karry dem go difren kountry like sey na heavy breeze blow dem. Den dis betta land go turn where pipol nor dey stay again and where dem dey trowey dirty put.”