Jeremaya 10:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
11 So Israel pipol make una tell di oda nashons sey: ‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart. So dem go disappear komot from di eart and heavens.’
I go set fire for Egypt gods temple and Babilon pipol go burn dia gods or karry dem go. Just as shepad dey kill and remove all di lice wey dey en klot, na so too Babilon king go kill and remove Egypt pipol from dia land.
“Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.
For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again.
But wen dem wake-up di next day again, Dagon dey groun for di Kovenant Box front. Dis time, en head and hand don break komot and e liedan face di door. Na only di body remain.