Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 9:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 If anybody kill pesin, I go ponish am. I go kill any animal wey kill human being.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 9:5
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Reuben kon tell dem, “I nor tell una sey make una nor sin against di boy, but una nor gri listin to mi? So naw, wi must pay for di sin wey wi kommit!”


Not to tok about una wey do evil kon go kill pesin wey dey sleep for en own house! I go take revensh and as una kill-am, na so una go take die too!”


Yu know wetin yu go do, make yu sofa am well-well until e die.


Wen Atalaya, Ahazaya mama si sey en pikin don die, e kon kill evribody for di king family.


Di king forget di love wey Priest Jehoiada wey bi Zekaraya papa show am kon kill en pikin. Wen Zekaraya dey die, e shaut kry sey, “Make God si and ponish una for dis tin wey una dey do!”


But di pipol kill doz wey plan against Amor, den Josaya wey bi Amon pikin, dem kon make am king.


Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol, still dey kare for doz wey nor get helpa. E nor dey leave pipol wey dey sofa.


“Anybody wey nak and kill anoda pesin, dat pesin must die too.


Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.


If pesin beat pesin die, dem must kill dat pesin too.


Pesin wey kill any animal, go replace am. But pesin wey kill pesin, go die too.


“ ‘But if e use iron take nak pesin die, e must die too, bikos e kill pesin.


If na big stone e take kill di pesin, e must die too, bikos e kill pesin.


Or if na wood e take kill di pesin, e must die, bikos e kill pesin.


or e nak di pesin die, e must die too, bikos e kill pesin. Di family memba go take revensh. Anytime wey dem si di pesin wey kill dia broda, dem go kill-am too.


So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.


Na thru one man E make all di tribes wey dey di world and E tok di time and place where dem go find God rish,


But if pesin hate en neighbour kon hide for korna dey wait am, so dat e go attack and kill-am, den run go dis towns,


di pesin wey old pass for en family go sey make dem bring am kom, so dat dem go kill-am too.


God pay Abimelek back for di bad tins wey e do to en papa, bikos e kill en 70 brodas.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ