Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 9:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Una fit chop anytin wey still dey waka. As I give una di green plant, na so too I don give una evritin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 9:3
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Evritin wey I kreate for dis eart go dey fear una, both animals and birds for sky. Evritin wey dey creep for groun and di fish for inside sea, go dey under una pawa.


E nor go chop any animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, bikos e go make am unklean. Na mi bi di Oga una God.


As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin.


Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol.


Nor skata God work bikos of food. Evry food dey okay, but e nor good make yu chop wetin go spoil anoda pesin faith.


Since God dey welkom evribody, make una nor kondemn odas bikos dem chop or dem nor chop wetin una like.


Pipol sey, wi fit do evritin. Dat na true, but nor bi evritin dey good. Wi fit do evritin, but nor bi evritin dey good for di body.


But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.


But una fit kill una animals kon chop en meat for any town wey una wont. Una fit chop di animal wey God give una as una like. All of una, weda una dey klean or not, fit chop meat, just as una dey chop gazelle and deer.


So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ