22 Ham wey bi Kanaan papa kon si sey en papa dey naked and e kon tell en two brodas wey dey outside.
Ham shidren na Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
Shem and Jafet take di klot kon put am for dia shoulder. Den dem kon take back waka enter kon kover dia papa nakednes.
So e sey, “I curse Kanaan! Na en go bi slave to en brodas.”
Ham shidren na: Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
Make shame and disgrace follow dem, bikos dem sey, “Yes o-o! Wi don get am naw!”
Pipol wey dey laf dey sey, “Aha! Aha!” Make Yu porshu dem go back kon disgrace dem!
If yu and yor neighbour dey argue about sometin, e go good make una setol am between unasef and make yu nor tok about una sekret for publik.
“Di mout wey dey laf en papa and nor dey obey en mama kommand, bird from valley go plok am komot and vulture go chop am finish.
Una wey dey make una neighbours drink too mush, so dat dem go naked and disgrace demsef, na big curse dey una head.
“If yor broda do yu bad, make yu go tell am wetin e do. If e asept wetin yu tell am, yu don win yor broda back bi dat.
E nor dey happy with wiked pipol, but e dey happy with di trut.
My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.