2 Evritin wey I kreate for dis eart go dey fear una, both animals and birds for sky. Evritin wey dey creep for groun and di fish for inside sea, go dey under una pawa.
Den God sey, “Make wi kreate human being like Awasef, just as wi bi, so dat dem go bi oga ova di fish dem for sea and di birds for di sky, plus di kattles and ova di whole eart plus evritin wey dey inside.”
God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”
God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am.
“I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest.
For dat time, I go make kovenant with all di wild animals and birds, so dat dem nor go wound my pipol. I go still take di tins wey dem take dey fight war komot from di land kon let my pipol stay for peace.