Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 9:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 den I go remember di kovenant wey I make with una and evritin wey get life akordin to how dem bi. Wota nor go ever kom distroy di eart and evritin wey get life again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 9:15
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.


and with evritin wey dey alive: all di birds and animals, evritin wey follow yu kom out from di boat.


Na with dis word I take enter kovenant with yu; I promise sey I nor go ever distroy di eart with wota again.”


Wen ever I bring kloud make e kover di eart and di rainbow sign appear for di sky,


kon pray, “Di Oga wey bi Israel pipol God; e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for eart! Yu do wetin Yu promise yor pipol kon show dem yor love, bikos dem obey Yu with dia whole heart.


Naw, awa God, di One wey dey great, get pawa and dey mighty, di Pesin wey dey keep en kovenant of love wey nor dey fail, make Yu help us as wi dey sofa. Bikos from di time wey Assyria kings first win us kom rish naw, na sofa wi dey sofa: wi and awa kings, leaders, priests, profets, grand-grand papa dem and all awa pipol.


E remember en kovenant with dem kon sorry for dem, bikos of en love wey nor dey fail.


Make yu put di two stones for di priest garment shoulder, so dat e go stand for Israel sons and Aaron go karry dia name go meet God, just to dey always remind am about dem.


Make Yu remember yor promise and nor hate us. Nor disgrace Jerusalem, di place wey yor throne wey get glory, dey. Abeg, make Yu nor break di kovenant wey Yu make with us.


But I go still do di kovenant wey I make with yu wen yu dey small. I go make kovenant with yu wey go last forever.


E do dis tins to show en love for awa grand-grand papa dem and to remember di promise wey E give dem.


So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ