den I go remember di kovenant wey I make with una and evritin wey get life akordin to how dem bi. Wota nor go ever kom distroy di eart and evritin wey get life again.
“I promise una for Noah time sey I nor go use wota distroy di world again. Naw, I dey promise sey I nor go vex for una again and I nor go rebuke or ponish una again.
Na di same word God take keep dis heaven and eart dey wait for fire wey go kom. E keep dem dey wait Judgement day. Di day wen E go distroy di pipol wey nor dey fear am.