9 Di dove nor si anywhere pesh put, bikos wota still kover di eart, so e kom meet Noah back for di boat.
Noah wait for anoda seven days, den e send di dove go again.
Den Noah send anoda bird make e go si if di wota don dry finish.
So my soul go rest again, bikos God dey good to mi.
So, wetin bi all dis sheep wey dey pass like kloud; like doves wey dey go house?
Some of dem go run go di mountin like doves wey run from valley. All of dem go kry, bikos of dia sins.
Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest.
“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
For dat kountry, una nor go get peace or rest. And God go make una heart dey fear; una eye nor go dey si well and una soul go dey worry.