Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 7:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 And evritin wey get life for di eart kon die: di bird for sky, animals, both di ones for house and wiked ones; evritin wey dey di eart and all human being.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 7:21
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God make wild animals, kattle and evritin wey dey creep for groun akordin to dia kind. God kon si sey dem dey good.


So God kon tell Noah, “I don sey I go kill evritin wey dey dis eart, bikos bad tins full di eart bikos of dem. Naw I won distroy dem and di eart.


“I go make rain fall for di eart wey go distroy evritin wey get life under di sky. Evritin wey dey di eart go die,


Bikos seven days from naw, I go send rain kom di eart for forty days and forty nite kon kill evritin wey get life wey I kreate.”


den evribody wey dey live for dis life go die kon turn to san.


Di world don break to pieces; e don krack open kon dey shake well-well.


So, God don curse di world. Pipol dey pay for wetin dem do and dis na why dem dey die anyhow and na only few of dem remain for di world.


So di land go mourn, bikos evritin wey dey inside, go die. All di animals, birds and even fish, go die too.”


Dem go distroy evritin wey dem si like sey na fire burn dem. For dia front, di land bi like Eden Gardin, but wen dem don pass, e go bi like desert for dia back. Dem go distroy evritin finish.


I go swip both pipol and animals. I go distroy di birds for di sky and di fish for sea. I go turn wiked pipol place to where dem dey trowey dirty put kon distroy human being komot from dis eart.


Dem nor know wetin dey happen until wota kom karry dem go. Na like dat e go bi wen Man Pikin go kom.


Dat time, pipol dey chop and drink, even for di day wen Noah enter di ark, men and wimen still dey marry, until wota kon distroy all of dem.


Bikos of sin, di world dey sofa from God curse naw and nor bi bikos dem wont am like dat. But di world dey hope


Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry.


God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ