20 Di wota kon high rish twenty fit afta e don kover di mountins wey high pass.
Dis na how yu go make am: Di boat go long rish 400 fit, e go wide rish seventy-five fit and e go high rish forty-five fit.
Di wota kon kover di eart sotey e even kover di mountins wey high pass for di eart.
For di seventint day for di seven mont, di boat kon stay on-top one mountin wey dem dey koll Ararat.
Yu kover di eart with wota and di wota kover di mountins.
True-true, hills and mountins nor fit help us. But na only Yu wey bi awa Oga God, go fit help wi, yor pipol.