But for mi, I stay for di mountin just as I do for di first time for forty days and forty nite. For dat time, God still listin to mi kon sey E nor go distroy una.
Den I go stay for God present for anoda forty days and forty nite; I nor chop or drink anytin bikos of all di sins wey una don kommit wen una dey do wiked tins wey go make God vex well-well.
Dis tin happen wen I go di mountin go kollect di ten kommandment wey God make for una. I dey der for forty days and forty nite and I nor chop or drink anytin.