Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 6:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 “I go make rain fall for di eart wey go distroy evritin wey get life under di sky. Evritin wey dey di eart go die,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 6:17
33 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.


So God kon tell Noah, “I don sey I go kill evritin wey dey dis eart, bikos bad tins full di eart bikos of dem. Naw I won distroy dem and di eart.


Yu go make roof for di boat, finish am kon leave space wey rish eight inches from di top. Put one door for di boat and yu go divide am into three: di lowa one, di middle and di uppa one.


So Oga God sey, “I go distroy human being wey I kreate komot for dis eart; plus evritin, from human being go rish animals, join di ones wey dey creep for groun and di birds for di sky, bikos I dey vex sey I kreate dem.”


Two-two from evritin wey get life kom meet Noah inside di boat.


Di wota fall for di eart for forty days. As di wota dey many, di boat dey go up.


Bikos seven days from naw, I go send rain kom di eart for forty days and forty nite kon kill evritin wey get life wey I kreate.”


“Si! I dey make my kovenant with yu and yor shidren-shidren


Even before dia time end, wota don karry dem go.


E turn di land wey get fruit to land wey nor get anytin at-all, bikos of di wiked tins wey di pipol wey dey stay der, dey do.


Na God dey rule ova wota and E go bi king forever.


But I go make Egypt sojas heart strong, so dat dem go porshu una and pipol go honor mi, bikos of wetin I go do to Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.


God sey, “Na mi dey give una pawa. So why una dey fear ordinary men wey nor go last pass grass?


“I promise una for Noah time sey I nor go use wota distroy di world again. Naw, I dey promise sey I nor go vex for una again and I nor go rebuke or ponish una again.


“ ‘Mi wey bi God wey get pawa dey tell unasef sey, mi mysef go look and kare for my sheep,


“So naw, mi God wey get pawa dey tell una sey, I go judge both di strong and di weak sheep.


“So mi God dey tell una sey I dey against una. Naw, all doz nashons go dey look as I dey ponish una, bikos una don bi my enemy.


Tell di mountin for Israel sey make e hear wetin God dey tok; make e hear wetin mi di God wey get pawa dey tok. I dey tell di mountin, hills, river and di valley sey: I go send swod go distroy di place where pipol for dey woship juju.


I go attack Israel and Judah pipol like lion. Mi mysef go tear dem to pieces kon karry dem komot der and nobody go fit save dem.


I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before.


God build en house for di heavens and put di foundashon for dis eart. E draw di wota wey dey di sea kon pour am for di eart. En name na God!


Dem nor know wetin dey happen until wota kom karry dem go. Na like dat e go bi wen Man Pikin go kom.


Dat time, pipol dey chop and drink, even for di day wen Noah enter di ark, men and wimen still dey marry, until wota kon distroy all of dem.


and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.


Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.


God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.


Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.


bikos dem nor do wetin God tok. God get patient for dem wen Noah dey build di ark, but na only di eight pipol wey dey inside di ark save from di wota.


God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ