E dress am well, so dat di body go fit dey der for forty day, bikos dat na di normal time wey di body suppose last. Egypt pipol use seventy days take mourn for am.
‘My papa make mi swear wen e sey, “I go soon die. Make yu beri mi for di grave wey I dig for mysef for Kanaan.” Naw make I go beri my papa; den I go kom back.’ ”