26 So Josef die wen e bi one hundred and ten years. Afta dem don dress en body dem kon put am for one koffin for Egypt.
Abraham stay for one hundred and seventy-five years.
Jakob stay seventeen years for Egypt; so all di years wey Jakob stay, na one hundred and forty-seven years.
Jakob ansa Fero, “I don stay for more dan one hundred and thirty years. And all di years wey I don spend for dis life nor many, but e nor dey eazy; di years wey I don stay, nor many rish di years wey my grand-grand papa dem stay.”
Josef stay for Egypt with en papa family. Josef stay for one hundred and ten years.
Afta sometaim, Josef, en brodas and doz wey bi dia age mate kon die.
Afta all dis tins don happen, Joshua wey bi Nun pikin and God savant kon die wen e bi one hundred and ten years.