Wen Kanaan pipol wey dey stay di land si dem dey mourn for Atad, dem kon sey, “Wetin happen nor good at-all for Egypt pipol.” Dat na why dem dey koll di place Abel Mizraim and e dey afta Jordan River.
En sons karry am go Kanaan kon beri am for di grave wey dey Makpelah field near Mamre. Dis na di field wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin.