Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 5:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Di total days wey Adam live, na nine hundred and thirty years and e kon die.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 5:5
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu go sweat before yu chop, until di day wey yu go die go back to groun, where I from kreate yu.”


Di total life wey Enosh live na nine hundred and five years, den e kon die.


Afta Adam born Seth, e still stay for anoda eight hundred years and for dis time, e still born many sons and dotas.


Wen Seth don stay for one hundred and five years, e kon born Enosh.


Di total life wey Seth live na nine hundred and twelf years and e kon die.


One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.


Na Adam born Seth, Seth born Enosh, Enosh born Kenan


I know sey Yu dey karry mi go where I go for die; di place wey Yu keep for evribody.


Evribody go die, bikos nobody fit stay forever and nobody go fit run from grave pawa.


Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.


Remember am naw, before yu go kon dey fear to klimb high place or to waka for road; den yor hair go don turn white like almond tree wey dey shine and yu go hardli fit karry yorsef just like grasshoppa wey dey die; den all di mind to dey sleep with woman or man, go vanish and small time, yu go-go yor final resting place, den pipol go mourn for di street for yu.


By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.


Pipol wey dey alive naw, know sey one day dem go die, but pipol wey don die, nor know anytin and dem nor get any reward again; pipol nor dey remember dem again.


Make wi always let awa klot dey klean and spray betta perfume for body!


Na mi get evribody life, even una papa and mama plus dia shidren life, na mi get am. Di pesin wey sin, na-im go die.


Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”


Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ