3 Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.
Adam sleep with en wife again and e get belle kon born boy, den Eve koll am Seth, bikos e sey, “God don give mi anoda pikin wey go take Abel place. Abel wey Kain kill.”
Na both man and woman E kreate kon bless and koll dem, “Human being.”
Afta Adam born Seth, e still stay for anoda eight hundred years and for dis time, e still born many sons and dotas.
No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being.
Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?
Si, na for inside sin, dem born mi; Yes! Na rite from di time wey my mama get my belle.
Di angel ansa am, “Di Holy Spirit pawa go kover yu. So di pikin wey yu go born, go dey holy and dem go koll am God Pikin.
Kainan wey Arfaxad born, naim bi Shela papa. Arfaxad na Shem pikin, and Noah wey Lamek born, naim bi Shem papa.
Wetin flesh born, na flesh e bi, but wetin God Spirit born, na spirit e bi.
Na thru one man sin enter dis world and deat kom thru sin. So wi must die, bikos evribody don sin.
Pipol, animals, birds and fish, na flesh God take make all of dem, but all of dem get difren flesh.
Just as wi bi like di first man wey kom from eart, wi go bi like di sekond man wey kom from heaven.
All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.