Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 5:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 E koll di boy Noah kon sey, “Dis one go give us rest from all di hard-hard work wey wi dey do from dis groun wey Oga God don curse.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 5:29
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Lamek don live for one hundred and eight two years, e kon born boy.


Lamek live for five hundred and ninty five year afta e born Noah and e still get oda shidren.


So Oga God distroy evritin wey get life for di eart: pipol, animals, di ones wey dey creep for groun and birds for di sky. All of dem die komot di eart. Only Noah and doz wey dey with am for di boat, naim save.


Wen Noah wake-up from en sleep, e kon si wetin e sons do to am.


“I promise una for Noah time sey I nor go use wota distroy di world again. Naw, I dey promise sey I nor go vex for una again and I nor go rebuke or ponish una again.


Even if Noah, Daniel and Job dey stay der, dia good wey dem dey do, go save only dia own life.” God wey get pawa don tok.


even if Noah, Daniel and Job dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren, di betta tins wey dem do, go only save dia own life.”


Just like e happen for Noah time, na so Man Pikin go take kom.


Kainan wey Arfaxad born, naim bi Shela papa. Arfaxad na Shem pikin, and Noah wey Lamek born, naim bi Shem papa.


Bikos of sin, di world dey sofa from God curse naw and nor bi bikos dem wont am like dat. But di world dey hope


Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.


bikos dem nor do wetin God tok. God get patient for dem wen Noah dey build di ark, but na only di eight pipol wey dey inside di ark save from di wota.


God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ