God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.”
Wen Elisha dey sick di sickness wey finally kill-am, Jehoash wey bi Israel king go visit am kon dey kry for en front sey, “My papa! My papa! Di shariot and soja for Israel!”
di place where all di first-born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for heaven. Una don kom meet God wey go judge evribody and na-im dey make pipol pafet.