Una papa blessing dey great pass all di blessings wey dey from di mountins go rish di hills. Dis blessings go rest for Josef head, bikos e bi prince among en brodas.
So just as lion dey attack oda animals for bush, na so too dia enemies go attack dem and just as wolf bi for desert, na so too dem go distroy dem. Na leopard go dey guide di town and if anybody won kom out from di town, dem go distroy am, bikos dia sin too many and dem don turn from God.
Dia leaders bi like lion wey dey happy for di animal wey e kill. Dem kill pipol, take all dia money kon kollect di propaty wey dem fit kollect and naw, many wimen nor get husband again, bikos of dis tin wey dem do so.
Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee.