Jenesis 49:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
26 Una papa blessing dey great pass all di blessings wey dey from di mountins go rish di hills. Dis blessings go rest for Josef head, bikos e bi prince among en brodas.
Even doh di mountins and hills go skata, di love wey I get for una, nor go ever end. I go keep my peace and promise forever.” Na God wey love una, tok all dis tins.
Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.
Wen E stop, di eart go start to shake and wen E look, di nashons go bigin fear. All di mountins go skata; di hills wey dey since go sink and E go dey forever and ever.