16 Dan go rule pipol like any oda tribe for Israel.
Den Rashel sey, “God don save mi. E don ansa my prayers kon give mi boy pikin.” Dat na why Rashel koll di pikin Dan.
Wen e si how di kountry side bi and how di land good, e go fit bear di load wey e karry kon bi savant to odas.
Dan go bi like snake wey dey di road korna; like betta wiked snake wey dey bite horse leg, so dat who dey ride am go fall.
Doz wey dey Dan tribe dey waka with dia flag, na dem bi di rear guide wey dey work for all di kamp akordin to dia family; Na Ahiezer wey Ammishaddai born dey lead dem.
Moses pray for Dan tribe sey: “Dan pipol bi like yong lion wey dey kom out from Bashan.”
For dat time, Manoah, one man wey kom from Dan tribe, dey stay for Zorah. E nor get any pikin, bikos en wife neva born.
Samson lead Israel pipol for twenty years, even doh Filistia pipol still dey rule di land.