“Dem go kill Assyria pipol with swod for war and nor bi swod wey human being make. Assyria pipol go run from di swod and dem go turn dia yong men to slaves.
“Man pikin, Nebukadnezzar wey bi Babilon king dey go attack Tyre. E sey make en sojas karry heavy load and na dis make di hair for dia head fall komot and dia shoulder peel. But even with all dis hard work, di king and en sojas nor get any reward.