14 Issakar na very strong donkey wey dey rest on-top two strong bags.
Den Leah sey, “God don give mi my reward, bikos I give my savant to my husband make e sleep with am.” So e koll am Issakar.
Wen e si how di kountry side bi and how di land good, e go fit bear di load wey e karry kon bi savant to odas.
From Issakar: na 200 leaders and dia family; dem undastand evritin, plus wetin Israel pipol suppose do.
Even pipol wey dey stay for animal house, dey si doves wey get feadas wey dem make with silva and gold wey dey shine.
E choose David en savant, wen E koll am from where e for dey kare for sheep.
Den dem go near Moses kon sey, “Wi go build house here for awa animals and family,
Moses pray for Zebulun and Issakar tribe sey: “Zebulun pipol go prosper as dem dey travel. Make Issakar pipol prosper for dia house.
Afta Abimelek don die, one day, Tola wey dey stay Shamir for Efraim hill kountry, wey Puah bi en papa and na Dodo wey kom from Issakar tribe bi en grand-papa, kon save Israel pipol.