Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 48:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Naw, koncerning yor two pikin wey yu born for Egypt before I kom here, dem go mi my own. Just as Efraim and Manasseh bi my own, na so Reuben and Simeon go bi my own too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 48:5
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem born Manasseh and Efraim give Josef for Egypt. Potifara wey bi priest for On, na en dota Asenat born dem for Josef.


Afta dis, dem kon tell Josef, “Yor papa nor dey strong again.” So e take en two sons, Manasseh and Efraim go meet am.


But any pikin wey yu go born afta dem, go bi yor own; wen dem won share di propaty for di promise land, dia name go dey under Manasseh and Efraim name.


My God, wen di Red Sea si Yu, di wota kon dey fear and di sea shake rish bottom.


Naw, God wey kreate una sey, “Make una nor fear, I go save una. I don koll una by una name and una bi my pipol!


“ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ” Dis na wetin God wey get pawa dey tok.


God wey get pawa sey, “Dis na di land wey yu go divide among di twelf tribes for Israel. But Josef tribe go get two.


Una must dey holy to mi, bikos mi wey bi God dey holy and I don separate una as my own.


Oga God sey, “Dem go bi my pipol. For di day wey I go kom judge di world, na dem go bi my own. I go sorry for dem, just as papa dey sorry for en pikin wey serve am.


kon bi una Papa and una go bi my shidren.” Na so God wey get all di pawa, tok.


Before, God don already decide thru Jesus Christ sey, wi go bi en shidren, bikos na so E wont am.


Before Jakob die, na faith e take bless Josef shidren and woship God as e rest on-top en walkin stik.


Naw, make yu divide dis land among di nine and half tribes.”


Dem si Josef shidren as two tribe, Manasseh and Efraim. Dem nor give Levi pipol any land; aldo dem give dem towns where dem go stay, plus fields where dia animals go for dey chop.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ