2 Wen dem tell Jakob sey, “Yor pikin Josef don kom meet yu,” e kon get up sidan for en bed.
Afta dis, dem kon tell Josef, “Yor papa nor dey strong again.” So e take en two sons, Manasseh and Efraim go meet am.
Jakob tell Josef, “Di God wey get pawa appear to mi for Luz wey dey Kanaan land kon bless mi.
I tell dem how God help and dey with mi. I still tell dem evritin wey di king tell mi. Di pipol ansa, “Make wi start to ribuild di wall!” So dem kon ready to start di work.
God dey kare for dem wen dem dey sick kon make dem well again.
My pikin, if yu dey wise, I go happy well-well.
Finally, make una dey strong with Christ mighty pawa.
But yu go make Joshua di leader kon enkourage am, bikos na-im go take dis pipol cross kon make dem get di land wey yu go si.”
Den Saul pikin Jonatan go meet David for Horesh kon tell am, “God go always guide yu.”