Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 48:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 For dis time, Jakob nor dey si well again, bikos e don old well-well. So Josef take en sons near am well-well and en papa hold dem near en body kon kiss dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 48:10
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Isaak don old well-well and e nor dey si well again, e koll en senior pikin Esau kon tell am, “My pikin!” Esau ansa, “Papa, na mi bi dis!”


So Jakob waka go kiss am. Wen Isaak feel as en klot dey smell, e kon bless am sey, “Yes, my pikin dey smell like sey e dey inside bush wey God don bless.


Very early for di next morning, Laban wake-up kon kiss en grand-shidren and en dotas, den e bless dem. Den Laban kon go en house.


Josef kiss all en brodas as e dey kry. Afta, en brodas kon follow am tok.


Israel tell Josef, “I nor bilive sey I go si yu again, but naw, God don let mi even si yor shidren too.”


Wen Jakob si Josef sons, e kon ask, “Na who bi dis?”


So, Elisha leave en melu dem kon follow Elijah, den e sey, “Make I go tell my papa and mama, ‘Bye-bye,’ den I go follow yu.” Den Elijah ansa, “Okay! Make yu go tell dem, but tink am well-well, before yu kom follow mi!”


Remember am before doz wey dey guide yor house bigin shake with fear. Dat time, yor strong men go don dey weak. Make yu remember am naw, before yor tit go pul finish and yor eyes nor go fit si well again.


Make una nor tink sey God dey too weak to save una or dey deaf to hear wen una koll am for help!


Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”


Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy.


One nite, Eli wey nor dey si well-well again dey sleep for en room


Dis time, Eli na ninty-eight years. En eyes open, but e nor dey fit si well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ