Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 47:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Wen una don harvest wetin una plant, make una divide am into ten kon give five part to Fero and una with una family fit chop di rest.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 47:24
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make all praiz bi di Most High God own, di one wey diliver yor enemies put for yor hand.” Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.


Den Sodom king kon tell Abram sey, “Abeg give mi di pipol, make yu take evry oda tin.”


Den dis stone wey I dey keep der as holy stone, go bi God house and I go make sure sey I give Yu back one out of evry ten tin wey Yu give mi.”


Den make Fero choose one pesin wey go supavise di whole land for Egypt, so dat if dem divide all di tins for Egypt into ten, dem go kollect five part keep for di time wen evritin dey good.


Josef kon tell di pipol, “Since I don buy una and una land for Fero, make una take seed kon go plant for di land.


Dem ansa, “Yu don save awa life! Yu don show us favor and wi go bi Fero savants.”


Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.


Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol! God dey always save dem from trobol.


“ ‘One out of evry ten tin for wetin grow for di land, weda na grain or fruit, go bi God own.


One out of evry ten animal wey dey stay house, go bi God own. Wen dem don kount di animals finish, di tent one go bi God own.


“I don give Levi pipol all di tithes wey Israel pipol give mi. Dis na to pay dem for dia work wey bi to kare for di tent where dem for dey do meetin.


Una must make sure sey una dey give God one from evry ten tin wey una get or harvest dat year.


Evry three years, una must offa special tithe for una plants. For dat year, una must give una tithe to Levi pipol, di strenjas, doz wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go dey si food chop for di town.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ