But e nor buy di priests land, bikos di priests get favor from Fero eye, so dem dey chop from di share wey Fero give dem. Dat na why dem nor sell dia land.
So, make yu go plant yor seed for morning and nor stop to work until evening; bikos yu nor know di one wey yu do wey go bring gain for yu; weda na dis one, dat one or di two.
Bikos na God dey give seed to farmer and provide bread wey pipol go chop. Like dis too, E go provide and di tins wey una nid, go plenty well-well and dem go last forever.