So Josef buy all di land for Egypt kon gi-am to Fero. Evribody for Egypt sell dia field, bikos di honga dey strong evriday. So all di land for Egypt kon bi Fero own.
But e nor buy di priests land, bikos di priests get favor from Fero eye, so dem dey chop from di share wey Fero give dem. Dat na why dem nor sell dia land.