Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 47:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Wetin go make us die for yor eye; both wi and awa land. Make yu buy wi and awa land and wi and awa land go bi Fero own. Just give us food, so dat wi nor go die. Den di land nor go dey empty.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 47:19
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make dem keep all dis food for di land until di seven years wey honga go dey, go start. Like dis, di land go fit survive di honga.”


So wen Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, all di pipol for Egypt kon go meet Josef dey sey, “Make yu give us food! Abi yu wont make wi die for yor front, bikos awa money don finish?”


Wen dat year don finish, dem kon meet am di next year dey sey, “Wi nor fit hide am from awa oga sey di money and all awa animals don finish.


So Josef buy all di land for Egypt kon gi-am to Fero. Evribody for Egypt sell dia field, bikos di honga dey strong evriday. So all di land for Egypt kon bi Fero own.


Satan ansa, “Di true bi sey, pesin go give Yu evritin wey e get, so dat e nor go die.


En pipol dey feel di pain and dem dey find wetin dem go chop. E sell en betta-betta tins make e for si money take buy food chop, so dat e nor go die. So e kry, “My God, make Yu look kon si as I dey sofa.”


Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us.


Wi dey risk awa life as wi dey find food wey wi go chop, bikos tif many for di towns and di village dem.


Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ