Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 47:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, so Josef kollect and karry all di money go give Fero for en palis.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 47:14
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As di honga dey evriwhere for di world, Josef kon open di store where e keep food put kon dey sell food give Egypt pipol. Di honga for di whole Egypt strong well-well.


Pipol from evry kountry dey kom buy food from Josef for Egypt, bikos di honga strong well-well.


So wen Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, all di pipol for Egypt kon go meet Josef dey sey, “Make yu give us food! Abi yu wont make wi die for yor front, bikos awa money don finish?”


Pipol go curse di pesin wey store en korn dey wait who go buy am for high prize; but dem go praiz doz wey sell am for di normal prize.


God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ