Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 47:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Josef still provide food for en papa, en brodas, all en papa pipol, akordin to di shidren wey dem get.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 47:12
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una go dey for Goshen land and una go dey near mi; both una, una shidren, una grand-shidren, una animals and plants and evritin wey una get.


I go provide food for una for here, bikos dis honga go still last for five years. If not, una go soon dey poor; both una and una family and evribody and tins wey bilong to una.” ’


So God send mi kom for una front, so dat una go dey di eart and una nor go die.


Josef kon go tell Fero sey, “My papa, my brodas, dia animals and evritin wey dem get don kom from Kanaan. Dem dey for Goshen.”


So Josef kon make evribody for Egypt turn slave.


Wen una don harvest wetin una plant, make una divide am into ten kon give five part to Fero and una with una family fit chop di rest.”


So, make una nor fear. Evritin wey una wont, I go give una and una shidren and family.” Den e follow dem tok well.


Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.


En whole family go dey popula bikos of am, dat is evribody wey rilate to am, go dey popula. Bikos of am, en family go balance like plate and pot wey dem hang for wall.


Wen wi dey with una, wi dey gentol like as mama dey kare for en pikin, even doh wi for fit kollect money from una since wi bi Christ apostles.


Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.


But if di woman get shidren or grand-shidren, di first tin wey dem go do for dia family, na to show sey dem dey fear God, as dem dey kare for dia papa and mama. Dis na wetin dey make belle sweet God.


But if anybody nor fit kare for en pipol, especially en family membas, e don deny di faith bi dat and e worse pass sina.


E go enkourage and provide for yu wen yu don old, bikos yor pikin wife wey love yu, don born boy for yu. And wi know sey di woman betta pass seven boys to yu!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ