Den make una tell am sey, ‘Yor savants dey kare for animals since wi bi small pikin kon rish naw, both wi and awa papa.’ Make una tok like dat, so dat una go fit stay for Goshen land, bikos Egypt pipol nor like pipol wey dey kare for animals.”
Egypt dey yor hand, so make yu do as yu like to yor papa and brodas. Dem fit stay for Goshen and if yu know any strong one among dem, yu fit gi-am my animals make e guide dem.”
En whole family go dey popula bikos of am, dat is evribody wey rilate to am, go dey popula. Bikos of am, en family go balance like plate and pot wey dem hang for wall.
Israel pipol komot from Egypt for di fifteent day for di first mont wey bi di day afta di Passova. For Egypt pipol present, dem kon komot from Rameses town and God guide dem.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.