29 Josef klimb en shariot kon go meet en papa Israel, for Goshen. Wen e meet am, e hug am kon bigin kry.
But Esau run go meet am kon hug and kiss am. Den di two of dem kon dey kry.
Fero gi-am di shariot wey di pesin afta di king dey ride and e sey, “Make una knee down for am!” So Fero make am oga ova all di land for Egypt.
Josef rush go outside, bikos e nor fit bear as e dey si en brodas and e don nearly won kry. So e go en room kon kry well-well for der.
Make yu still tell dem sey, ‘Make una do like dis: Una go karry horse wey dey karry load from dis land kon go karry una family kom from Kanaan; both una wifes and shidren. Make una bring una papa kom too.
E kry well-well; Egypt pipol and evribody plus Fero sef, hear about wetin happen.
So Israel sons kon do as Josef tell dem. Josef give dem horse wey dey karry load, just as Fero tok kon give dem tins wey dem go nid for dia journey.
Israel kon tell Josef, “As long as I don si yor face kon know sey yu dey alive, I fit die naw.”
War horse and di driver still follow am go, so pipol wey follow am many well-well.
So e get up kon go meet en papa. “But wen en papa si am dey kom from far, e sorry for am, run go meet am, hold am near body kon kiss am.
All of dem start to kry, as dem draw Paul near body kon dey kiss am.