21 Benjamin sons na: Bela, Beka, Ashbel, Gera, Naaman, Ehi, Rosh, Muppim, Huppim and Ard.
All dis na Rashel sons wey dem born give Jakob and dem bi fourteen.
Benjamin go bi like wolf wey dey skata en enemy. For morning, e dey distroy wetin e katch and for evening, e dey divide wetin e katch.”
E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey, “Make David get out! Wi nor go follow am again! Israel men, make wi dey go awa house!”
Moses pray for Benjamin tribe sey: “God love Benjamin pipol and dem dey save under am. E dey gada dem from evry side, so dat nor-tin go do dem.”