17 Asher sons na: Imnah, Ishvah, Ishvi, Beraya and Serah wey bi dia sista. Beraya sons na Heba and Malkiel.
Leah kon sey, “My belle dey sweet mi, bikos wimen go dey happy well-well, bikos of mi!” So e koll di pikin Asher.
Di sons wey Zilpah, Leah savant born na Gad and Asher. All dis na Jakob sons wey dem born for am for Paddan Aram.
All dis na di shidren wey Leah savant, Zilpah born. E born dem for Jakob and all of dem na sixteen.
Na rish-rish food Asher go dey chop and e go dey provide betta food for kings.
Dan, Josef, Benjamin, Naftali Gad and Asher.
Moses pray for Asher tribe sey: “Make God bless Asher pipol pass evry oda sons; make en brodas karry am high and Asher pipol go dey wosh dia own legs with olive oil.