Dis na shidren wey dem born for David wen e dey Hebron: Di first pikin na Amnon, en mama na Ahinoam wey kom from Jezrel: di sekond one na Daniel, en mama name na Abigail, wey kom from Karmel.
Utai family dey among di ones wey kom back to Jerusalem. Utai na Ammihud pikin and na Omri bi en grand-papa. Na Imri wey Bani born, bi Omri papa and na Perez wey Judah born bi Bani papa.
Petahaya wey Meshezabel born wey dey among Zera shidren-shidren from Judah tribe, na-im dey advise di king for all di matter wey koncern how to rule and kontrol di pipol.
Moses pray for Judah tribe sey: “My God, make Yu hear Judah pipol kry kon bring dem togeda as one. Make Yu give dem pawa to take fight and win dia enemies!”
Den one among di eldas kon tell mi, “Make yu nor kry again! Look, di lion for Judah tribe, wey kom from David family, don win. So e go open di book and break di seven keys.”