Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 45:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Naw, make una nor fear or dey vex with unasef, bikos even doh una sell mi kom here, na God send mi go for una front, so dat pipol life go dey save!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 45:5
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.


Dem ansa, “Yu don save awa life! Yu don show us favor and wi go bi Fero savants.”


But Josef ansa dem, “Make una nor fear. Na God know wetin E won do.


Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.


So, make una nor fear. Evritin wey una wont, I go give una and una shidren and family.” Den e follow dem tok well.


Yu sin for sekret, but I go make dis tin happen for publik make all Israel pipol si am.”


Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.


If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”


Den e sey, “Dem nor born mi with anytin and wen I die, I nor go karry anytin follow body. Na God dey give and E don take. Make wi praiz God name!”


(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.


so dat Satan nor go deceive us, bikos wi know en wayo.


So make una forgive and help am, so dat e nor go luz hope and life nor go taya am.


May bi na bikos of dis make am nor dey with yu since, but naw, e go dey with yu forever.


Di next day, Elkanah and en family wake-up for early morning go woship God, den dem kon go back to dia house for Rama. Elkanah sleep with en wife Hannah and God kon remember am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ