E give dem part for di food wey dem gi-am, but di one wey e give Benjamin, big pass dia own five times. Dem chop and drink with Josef until drink kon katch dem.
E send dis tins go meet en papa: ten donkey wey karry di best goods for Egypt and ten woman donkey wey karry korn, food and di tins wey en papa go nid for en journey.
Siria king kon sey, “Make yu go meet am and I go give yu leta wey yu go give Israel king.” So as Naaman dey go, e karry silva wey heavy rish 750 pounds; gold wey heavy rish 150 pound and ten difren klot.
Den dem give each of dem long white klot kon sey, make una rest small until di oda savants and una brodas for Christ wey wiked pipol go kill, don komplete.
So Samson tell dem, “Make I tell una one problem, if una fit solve am for di next seven days, I go give una thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party.
At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.