14 Den Josef hold en broda Benjamin near body kon kry well-well and Benjamin kon dey kry too.
Den Jakob kiss Rashel kon dey kry.
But Esau run go meet am kon hug and kiss am. Den di two of dem kon dey kry.
So Josef turn from dem kon dey kry. Wen e turn face dem again, e kon sey make dem go put Simeon for prison as all of dem dey look.
Josef rush go outside, bikos e nor fit bear as e dey si en brodas and e don nearly won kry. So e go en room kon kry well-well for der.
Josef kiss all en brodas as e dey kry. Afta, en brodas kon follow am tok.
E kry well-well; Egypt pipol and evribody plus Fero sef, hear about wetin happen.
Josef klimb en shariot kon go meet en papa Israel, for Goshen. Wen e meet am, e hug am kon bigin kry.
So e get up kon go meet en papa. “But wen en papa si am dey kom from far, e sorry for am, run go meet am, hold am near body kon kiss am.
Dem nor get sense, dem dey promise and fail, dem nor dey do good or sorry for pipol.