But anybody hand wey yu for si yor gods, go die. For all dis men present make yu point di tin wey I karry wey bi yor own, den make yu take am.” Naw Jakob nor know sey na Rashel tif di gods.
But di men kon dey fear wen dem take dem enter Josef house. Dem kon sey, “Dem bring us kom here, bikos of dat money wey wi si for awa sak dat time. E won katch us, turn us to en slave kon take awa donkey!”
Judah ansa, “My oga, wetin wi go fit tell yu? Wetin wi go fit tok? How wi go fit take free awasef? God don espose awa sin! My oga, wi don bi yor savant, wi and di pesin wey dem si di cup for en sak.”
I nor do bad and I nor kommit any offence wey dem fit take kill mi, I nor dey try to run sey make dem nor kill mi, but if evritin wey dem tok against mi nor bi true, nobody go fit karry mi, give dem. I sey make dem karry my kase go give Caesar!”