22 Wi tell awa oga sey, ‘Di boy nor go fit leave en papa. If e leave en papa, di papa go die.’
But Jakob ansa, “Benjamin nor go follow una go anywhere, bikos en broda don die and na only en remain naw. If anytin happen to am wen una dey travel, den una go just make mi die with pain.”
Den yu tell us yor savants sey, ‘Make una go bring am kom make I si am.’
But yu tell yor savants sey, ‘If una yonga broda nor follow una kom, una nor go si my face again.’
“So naw, how wi won take go back to yor savant, awa papa and di boy nor dey with us; bikos en life dey inside dis en pikin life.